Many abortion medicine full market and dem dey available around the world. Myfegyne dey among the ones wey common pass. Whether you dey concerned about how Mifegyne dey work, the price, the dosage or where to get am, we hope say dis guide go dey useful. If you get extra question, abeg contact our counsellors and we go dey happy to help.
Wetin be Mifegyne Abortion Medicine?
Mifegyne na brand of Mifepristone, and na medicine to commot belle wey don reach up to 13 weeks. Mifegyne dey block the hormone wey the belle need to grow. Na Exelgyn, one French Pharmaceutical company dey produce Mifegyne. [1], [4]
Photo credit: Mifegyne pills https://www.indiamart.com/
Photo credit: Mifegyne pill https://www.ledevoir.com/
Photo credit: Mifegyne pills https://rewire.news/
How Mifegyne Dey Work for Abortion?
Mifegyne dey block the effect of progesterone, wey be natural hormone the belle need to grow. E no go let the belle grow, and e go prepare the uterus to contract and the cervix to soften and dilate. E go start work within 24-48 hours after you don use am. [2]
For abortion, you go combine Mifegyne wit prostaglandin medicine (like Misoprostol, Cytotec, Misotrol), e go help the cervix soften and dilate, and the uterus to contract. [1]
Mifegyne Dosage
Mifegyne dey come for 200mg medicine, dis na the amount wey dem recommend for belle wey dey under 13 weeks. You go put am for mouth, swallow am. Wait for 24-48 hours after you don use Mifegyne, then use prostaglandin medicine (like Misoprostol, Cytotec, Misotrol). [1], [2]
The amount of prostaglandin wey dem recommend go depend on how long the belle don dey, see wetin dem talk here for more information.
The Dose of Mifegyne and Misoprostol for Women wey dia belle dey Under 9 Weeks: You go need 1 Mifegyne medicine and 4 Misoprostol medicine, and e dey recommended to get extra 4 Misoprostol medicine (na total of 8 Misoprostol medicine).
The Dose of Mifegyne and Misoprostol for Women wey dia belle dey Between 9-13 Weeks: You go need 1 Mifegyne medicine and at least 4 Misoprostol medicine, but dem strongly recommend say make you get extra 4 Misoprostol medicine (na total of 8 Misoprostol medicine) since your belle dey between 9-13 weeks. If e dey hard to get 8 medicine, you fit continue wit only 4 Misoprostol medicine, but e no go work as e suppose work.
Price of Mifegyne
The price of Mifegyne depend on top the area wey you dey live. Different countries get different laws about abortion, and e fit also affect the price of Mifegyne.
Organizations dey wey dey give the medicine as donation, you fit check Women on Web and Women Help Women for more information about how to get Mifegyne. [4]
How to Take Mifegyne
safe2choose recommend say make you swallow 1 Mifegyne medicine (200mg) wit water. If you vomit for the first 30 minutes after you don swallow the Mifegyne medicine, e dey likely say the medicine no go work and you go need to take anoda Mifegyne tablet.
Wait 24-48 hours after you don take the Mifegyne medicine, and then use the prostaglandin dose wey dem recommended.
The instructions and the amount the prostaglandin medicine to use depend on how long the belle don dey, find the information wey full ground about am here.
Mifegyne Side Effect
Mifegyne fit increase make e be like say person wan vomit like wen person get belle, and e possible say e fit cause abdominal cramping and bleeding. Most times, cramping and bleeding go happen only after you don use prostaglandin medicine wit the Mifegyne medicine.
Wetin Mifegyne Abortion Medicine Resemble?
Mifegyne na 200mg tablet. The tablet be light yellow, cylindrical, biconvex, wit diameter wey be 11 mm and dem write “167 B” for the side. [2]
The pack size fit be 1 medicine, 3 medicine, 15 medicine, or 30 medicine. [4]
How to Get Mifegyne Abortion Medicine
Mifegyne abortion medicine fit dey available but e depend for where you dey live and the abortion law wey dey there.
We know say Mifegyne dey available for dis countries: Austria, Belgium, Bulgaria, Cote d’Ivoire, Denmark, Estonia, Finland, France, Germany, Greece, Italy, Netherlands, New Zealand, Norway, Portugal, Romania, Russian, FederationSlovenia, South Africa, Sweden, Tunisia, United Kingdom. [4]
Dis website dey useful to find where you fit get Mifegyne for your area [5]
You fit contact our counselors, dem go fit help you find where you fit trust to go buy am.
[1] Exelgyn. Homepage. Retrieve from: https://www.exelgyn.com/
[2] https://www.medicines.org.uk/emc/medicine/617#INDICATIONS
[3] Ipas. (2019). Clinical Updates in Reproductive Health. L. Castleman & N. Kapp (Eds.). Chapel Hill, NC: Ipas. Retrieved from: https://ipas.azureedge.net/files/CURHE19-april-ClinicalUpdatesInReproductiveHealth.pdf
[4] IPPF. Medical Commodities Database. Retrieved from: https://www.medab.org/advanced-search-multiple
[5] Women On Waves. Map Countries. Retrieved from: https://www.womenonwaves.org/en/map/country